in ,

Covid-19: Popular Lagos business mogul shares secret to keeping her customers happy even during the lockdown

In times like this, you need money. You not only need money, cool cash, you also need to spend the mula wisely. If you’re following what’s been happening around the world, you should understand. Since this corona palava , to sell market nawa. Government say make we no comot, if we no dey sell food or drug , our market no essential.  But me I be cash madam, I dey sell food and every other thing so my customers need me.

Madam Cash or Cash Madam (as I am popularly called) na trader wey open eye I be. Everybody in this Lagos know me. I be young woman wey dey run food business. So when they announce the lockdown, I don reason how I go take do am. Come make I gist you how I dey take run my business from my house.

First, I don know say I go need plenty credit and data to reach my plenty customers that is why I no dey joke with my MTN4Me. MTN don look me so tay dem know say I dey use data and credit equally so everyday them dey tell me the kind deal wey dey available for me.  All I need to do is dial *121#, all my options go just arrange for me and I go pick the one I need wey go help me manage my customers for our WhatsApp group and wey go give me enough credit to call my delivery people.

I know my daughter dey always tell me say I fit use the app too, say I go just crack-the-egg and my gift go dey wait for me, maybe I go try that style tomorrow but this one wey I dey use don okay me like this.

The funny thing be say, the offer wey me I get no be the same thing wey my husband go get or wey my customers dey get. MTN don study all of us and the kind lifestyle we get and don package our gift to resemble us. Ah, technology sha!

Anyway, nice to meet all of you o, make I go reply Mama Onome on the group page, she dey ask me if I get change to give the deliveryman. Who go collect cash in this coro-era? No be me. Make I go tell am to use MTN MoMo wire my money and if she wan argue, I go tell am say na free of charge.

As proper Ijebu businesswoman wey me Cash madam be, I no dey use my money joke. 

Encomium

Written by Encomium

A media, tech and events company.

What do you think?

Leave a Reply

Avatar

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Here are the major headlines for Saturday, May 2, 2020

Buhari commends, charges media on World Press Freedom Day